31/05/2014
OGA PASS OGA
If we cry from January to December I no think say e go fit change our oga mind to say she no go leave us again.
Some of us don develop inner problem wey oyibo people dey call heartachelaria
Many of us wey don marry dey inside our kitchen dey give our husband dem burn burn food where we still dey imagine weda na true wetin our oga dey talk abi na APRIL FOOL she just won do us
CHAI! CHAI! .!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!! God o!
The plead we are begging for our mother, friend, sister, cousin, wife, Boss not to leave us is so plenty that if we have the power we will not allow her to step an inch away from us,
SHOP ABI NO BE TRUE I TALK?
Original mama
God sent Boss
Peculiar mother
One in town councellor
Na who fit resemble you for ur waka, smiles, advice, prayers, caring heart and even how you take dey fight for all of us ,
If to say na wresting competition you dey go , I for say make you siddon for house make I go fight for you, even though dem go finish me , I no mind come back with one leg and one hand, but God forbid because I know say pikin wey you train dey chop, so I MUST make sure say I win the fight.
We never still see oga wey go resemble you but we belive say for the fact say you go still leave your chair wey you take dey guide and lead us for the next person , that angel wey dey help you go help the person too IJN .
One and only Boss,
Na who go fit battle with your love ,
Na who go fit carry the load wey you carry , even for night wey you suppose sleep na soso your children you dey think about,
Time wey you go take follow your family jolly, you take am dey prepare time table
Time wey you go take sleep or rest small you still take am dey protect us, HABA!
Even if we empty our acct for you e no go reach to take thank you for all the berekete things wey you dey do for us
I swear, If no b say i dey see you for office face to face ,I for think say God forget one of Him angel for earth waka go up
Her Royal Highness ma, we won take this opportunity take hail your husband wey don dey support you and allow you take care of us, him no resemble men wey go say" na you get the bank?
Our Boss husband,"" oga mi sir"" we trowey headdress for you and pray that our good God will continue to bless and keep you both IJN.
We love you and will not stop loving you.
I won continue dey write but make I stop here bcos my TL fit no see me for CMS bcos I just divert to costain bustop. No b my mouth una go hear say okro dey draw o!.
Aunty Lola no mind them o! I know say you dey see me well for CMS na me stand for front so!!!
Mama hope to work with you again, incase you travel go abroad abeg i no mind to come b your cook or cleaner bcos i hear say no be me go dey do the job na electric work, but me go like do manual so that peper go rest. I don do my international passport dey wait make that one for no b excuse. lol!
Will surely miss you so so dearly.
Na still me d only pikin wey dey use bottle grammer dey make you laugh despite your oyibo nature.
Happy Hour