08/09/2025
Ju;ju for Court, my own experience 👇
When them call me to Bar for 2017, I start to practice for 2018 because na December period them call me to Bar.
So, for 2018, I join one law firm and my principal (boss for office) send me go Customary Court go do one land case. Me I sabi go Court early. I dey like reach Court, settle down before Court sit.
As I reach, my client don reach before me. Me and am talk finish. Then, I come sit down, dey write something because na Cross-examination I come do.
So, my client 0pponent come meet me, the first thing him do na to tap me. The way I react, him understand say I no like the way him tap me. I greet am like elder. I bend my head dey write and I dey greet am.
Next thing, him say him one talk to me. I drop pen but I no look him face. I tell am "okay Sir, I am listening". The man say make I look him face.
I just look remove eye. I tell to talk say I dey hear am. Him say make I look am eye ball to eye ball if him dey talk to me. I been no realize wetin dey happen. I no even carry anything for mind. 🤣
I tell am "papa, I am all ears". Him say him no fit dey talk to who no dey look am.
I tell am, okay. I carry my pen begin write wetin I dey write. Him tap me again say him wan talk to me. Na there I sh0ut say if him t0uch me again, say I go s,ue am for bat;-tery and arr,est am for ass!;ault.
As I raise my v0ice, him come go sit down.
Na later I come realize say that man been wan do my ju;ju for Court.🤣 When I tell my boss, him come dey laugh. Him say the man carry ju:ju and say na why him want make I look him face and say if to say I focus for him face, say something for go wrong for the case.
You see land case, e no easy ooo